Fake miracles fake prophets

Fake fake pastors,  fake fake miracles..
The fake miracle wet one pastor or na prophet wet them dey call prophet Miracle Adjija,  done come out open to everyone. You know say them talk say when breaze blow,  Foul yash go open.. The prophet dey pay people money make them act like say them no nomal,  or like say them be witch .. Some times na 5000 NGN to 7000 NGN him dey pay him actors. And many of e workers know about am,  na them dey go arrange the people for am. this kind thing don dey go on since. All this things go don't cause katakata or wahala for some of e church people .. Many homes go don break down,  yet him and e family dey enjoy. This big popular church dey for worry.

God don cash am now. This one go teach many of us leason,  we go dey spend all our time for where all this people wey dem claim man of God. Them go dey deceive us and dey enjoy themself.
Say no to fake pastors and prophets. Even the bible talk am too say: for the last days many people go claim say them know God,  them go do many signs and wonders, . but Jesus no know them.. So we need to be careful and no dey allow this kind people pour sand for our eye.
Na almost every day we dey hear all this kind story. Yet people no wan get sence.
This na wetin I see talk, base in wetin dey happen around.. But if you think say I no talk wella Oya hit me.. Talk your own below make we see..
I still remain your guy Aproko PdR

Comments

Popular Posts